Monday, 15 April 2024

Nigerians get grace

Nigerians get grace, anything wey you dey do try make sure say one Naija person dey there, e get why.

• When Napoli dey find league title because e don tey wey dem carry am last, naso Victor Osimhen enter, guess what?, Victor Osimhen goal against Udinese follow give Napoli their first league title in 33 years.

• E don tey wey Bayer Leverkusen win trophy infact e don reach 31 years wey Bayer Leverkusen win trophy, di last time wey Bayer Leverkusen touch trophy,  na hand referee dey use do whistle but as soon as Naija enter with grace everything change.

• Bayer Leverkusen go win Bundesliga if dem win Werder Bremen today and e go be their first ever league title in their history.

• Victor Boniface go score that one sure, abeg make una get ready, today all of us go support Bayer Leverkusen, Bayern Munich don too win that league.

No comments: